Skip to content

Jephthah Idahosa – Just Believe [MP3, Video and Lyrics]

Just Believe Download, Video and Lyrics | Jephthah IdahosaJust Believe Jephthah Idahosa

Lyrics for Just Believe By Jephthah Idahosa

Oh Oh Oh… oh
Oh oh oh oh oh oh oh
Oh

Oh Oh Oh… oh
Oh oh oh oh oh oh oh
Oh

[Verse 1]
I know sometimes my brother, my sister
Life fit dey hard for you to live
Kata kata dey everywhere you turn
E be like say tomorrow no go reach
But no be today the thing dey start

Ecclesiastes Chapter 1 [Verse] 9 say
“There’s nothing new under the sun”
Person don see am before
So make you sit back and relax
And hear the tori wey I dey talk
Oya pay attention to the lines

Make you know say God fit turn everything around

[Chorus]
Just believe
No dey doubt
Trust in God
He will turn it all around

No wahala
(Pass Him power)
Pass Him power
(He will deliver)
He will deliver
He will turn it all around

[Verse 2]
E get one guy him name na Joseph
Na so so dream Joseph dey dream
The sun, the moom and eleven stars
Bin dey bow to Joseph for him dream

But no be everyone around
Dey bubble with joy at your success
Certain people no dey gree
Say make you move forward in life
Na why they sell Joseph comot
Na so him brothers bin rejoice
Say “make we see wetin him go be
And all him dreams no go ever ever see the light”

[Chorus]
Just believe
No dey doubt
Trust in God
He will turn it all around

No wahala
(Pass Him power)
Pass Him power
(He will deliver)
He will deliver
He will turn it all around

[Verse 3]
Na so they carry him comot
They bin carry him go oVersea
They bin sell am for market, down in Egypt
Na Potiphar make the purchase
Na so Joseph come dey serve
E bin dey like say his hopes and dreams were gone
But Bible talk say God bin dey his side
And divine favour no leave him dormot

Na why Joseph start dey lead
Na double promotion him bin get
He bin dey manage Potiphar’s dormot
So tey Potiphar no dey fret at all
He just dey cruise, He just dey rise
Till Mrs Potiphar come spoil the show
She bin dey look him, She come dey trip
Sake of say him tap like die
She come dey toast him
She come dey say “Me and You, we fit run the show
We fit dey together, no one go know
Lemme be your mama, you fit be my guy!”

But Joseph no gree gel
He bin dey shun her every move
He bin dey do mai guard over him heart
Make he no go sin against the Lord

oh oh oh oh oh…

One fateful day, Joseph bin dey work
When Madam come dey talk
She come dey lure him, she bin dey prepared
She tell am say “Today na today!”
She tell herself, “He no fit resist me”
But there and then Joseph clear her doubt
He run comot, He kuku leave him dress
She come dey vex say she go show him

As Potiphar come show the house
Come see as Madam bin just dey act
She come dey cry, she just dey scream
Say na Joseph be the cause
Na so they carry him comot
They go lock am up for jail
E bin dey like say God no dey send
E bin dey like say…, God no dey hear

[Chorus]
Just believe
No dey doubt
Trust in God
He will turn it all around

No wahala
(Pass Him power)
Pass Him power
(He will deliver)
He will deliver
He will turn it all around

[Verse 4]
Na so Joseph dey for prison and two years come expire
But then Pharaoh had a dream
E le yi gidi gan (This one was strong)
He gathered all the men around
Say make dem come tell him the meaning
But all the wise men, magicians dem
Bin no fit code wetin e mean

Na then the butler start dey think
Na then him memory return
He say “Mr Pharaoh I know a man
Wey sabi the mata, he dey confirm”
Pharaoh say make them bring am come
Na so they rust Joseph comot

Out of prison, Royal demand
Straight to Pharaoh, Divine design

Ah, uh uh um um um um…

Pharaoh come talk the mata
He talk the dream
He come dey talk wetin he see
Joseph bin dey pay attention and he just dey smile
As the tori just dey flow

As Joseph start to talk, he said “Na God show you the mata
Oya pay attention, this is the meaning
Na so he just dey code the answer
When Pharaoh hear him talk, he said
“Na you be the answer! As you dey today, you no get challenge
Omo this your talent no be beans!”

Na so Joseph just dey watch
As Pharaoh carry him comot
Out of prison to a seat of power
Talk about from grass to grace!

Na so Joseph start dey rule
As the next in line after King Pharaoh
And all the people in all the lands
Bin dey come to Joseph to meet their needs

Even him brothers wey try delete him
They come dey bow down at his feet
They say “Please forgive us, we now believe
In all your dreams”

My brother, my sister
You don hear the tori wey I don talk
You still fit to go from grass to grace
So just believe…

[Chorus]
Just believe
No dey doubt
Trust in God
He will turn it all around

No wahala
(Pass Him power)
Pass Him power
(He will deliver)
He will deliver
He will turn it all around

He will turn it all around
(He will turn it all around)
He will turn it all around
(He will turn it all around)

If you no get money
(He will turn it all around)
If you dey sick for body
(He will turn it all around)

Just believe

Download Just Believe By Jephthah Idahosa (MP3)

GET AUDIO

Video Lyrics : Just Believe By Jephthah Idahosa

JUST BELIEVE (Lyric video) - Jephthah Idahosa Aigbe

Connect and Follow GospelSongsNG

FACEBOOK TWITTER TELEGRAM

1 thought on “Jephthah Idahosa – Just Believe [MP3, Video and Lyrics]”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *